Thursday 1 May 2014

buahahah chelsea fans still dey para

Plenty Chelsea fans no fit sleep
lass night as dem no believe say
Atletico Madrid fit enta dia house
kommot all dia front teeth juss
like dat.

Some Chelsea fans still dey for clinic sef where dokita dey knack dem
injection becos of de bad thing wey hapun lass nite for Stamford
Bridge.
Jedi Jedi also don dey worry some fans and naso dem dey rush enta
toilet like small pikin wey chop potty since lass nite wey Atletico
Madrid
kommot dem for road.

Na since lass week wey Chelsea don waka go follow Atletico Madrid play
0-0 for de fess leg for Spain, na hin all de Blues fans don dey shout
say Chelsea don enta de final be dat as dem believe say dem go win de
second leg for England.

But Atletico Madrid wey na dem kommot Barca for de kwatafinal no gree
for Chelsea as dem hama dem 3-1 for dia bed room.

Chelsea fans been dey dance azonto de time wey Torres helep dem score
de fess gol, but dem no know say tears go kommot for dia eyes wen de
match finish.

Meanwilly, Chelsea coachi Jose Mourinho no yab anybody dis time around
as de man even congratulate Atletico Madrid for hin banga soup
wey dem troway.

"Chai, na de second goal wey dem score us na hin give dem power and I
wan congratulate dem as dem don enta de final," naso Oga Mourinho
tok.

Wetin Chelsea go dey think now be how dem take win de BPL title for
dis season, but Liverpool leg dey dia pass dem.

No comments:

Post a Comment